E Tey Wey Breast Bin Siddon For Front. Pls Stop Child Molestation
by , May 7, 2012 at 11:30 PM (916 Views)
Abeg make those we no sabi nack beta creole pidgin english no fex.....na so the blog wey i wan write 2day go flow....make una just carry idea which is need to read am....abeg, nothing spoil
Every which way you turn na wan tori or the other you go hia about wan kain sad bad development wey dey happen for hawa contiri......i no go lie the matter dey bad gidi gan ni.
Even self those wey dey do advocacy for Nigeria(ngos) have their hands full.
For this korner, he dey dia, for dat korner, the wahal penti.
E be laik say wan kain demon don take over pata pata.
Oldmen dey wey dey poke small children, dem no mind say d child never sabi anything, dem just dey carry dem dorti fingers and boli to scatter everiwia.
Some na family member, and una go don hia of some wey be dereba for oga madam, or even tenant.
Some na housegirl or dem broda pikin wey dem talk say make she come help dem dey grab and defile.
http://deltawomen.blogspot.ca/2012/0....html?spref=fb
Some na orange hawker dem dey grab and defile. The kain thing wey dey happen dey make person wonder say make he no be say some demons from the pit of hell don invade the contiri o......haaaaaaa
The other day i begin nack all the tori wey i jam for different different place, na hin wan kain thing wey no long come begin shout say i dey disturb am. Se una see life so. Na jeje i dey shoot breeze o. I no sabi say people no dey like make person dey show say wahala dey......walahi wahala dey gan ni.
http://www.nigeriavillagesquare.com/forum/lounge/65019-just-becos-cases-mans-inhumanity-man.html
Dem bin talk say dem pass Child's Right Act, but the palava dey for under cloth, na from dia dem suppose start. Everi papa, everi mama, everi familic hand dey for inside dis matter.
Abeg se una sabi wia una pikin dey and wetin hin dey do?
Se no be say na housegirl/boy or wan uncle una leave una pikin wey be una future with?
Abeg make una shine una eyes well well o.....
The police wey dey for Lagos dey try no be small, but he get as e be sometimes with those judges dem o.....make una read am for this link for unaself.....ehen.
http://pmnewsnigeria.com/2012/05/07/i-am-a-rapist-man-tells-judge-referred-to-mental-hospital/
Anyway.......












Email Blog Entry