PDA

View Full Version : Chiagozie Is Here

chiagozie
Apr 4, 2009, 01:36 AM
While, as our dearly esteemed elders will say "no bi today nyash don siddon for back". wetin I mean be say I don tay small for dis area. I bin no no my way an i come mess up! I no ask de esteemed elders how I for take prostrate for ground. I com hia com dey waka about without any kin visa or even small ticket sef.
Now, I wan make amends, like the prodigal wey I bi.First of all, make I bellow serious nkpu with my vocal cord and beat gon for the biggest Iroko, sey I don sin and I wan make all elder forgive me.
I bin no wan talk my name first until I don apologise for all wrong don in the past. My name na Fredrick Chiagozie Nwonwu, I don be applicant for 4 years now (das why I dey float) and I dey write.I sabi small story writing and I dey also try for poem too.If una go accept dis my plea so...I go arrand serious traditional troope and unwatered palmwine with kola come see una. at the moment, na only my voice and my sackclothes na him follow me come (moto to take carry the palmi wey I for bring no dey.
Abi make una create small space for me, I ready to serve well well.
once again una doooooo

denker
Apr 6, 2009, 10:14 AM
chiagozie, my dear bruder, welcome and may Allah dey keep bless you well well...all gonna be well....cheers!

chiagozie
Apr 6, 2009, 09:40 PM
Thanks Denker, I appreciate your response. May more grease rub off your elbows.

chiagozie
Apr 6, 2009, 09:58 PM
In view of the fact that my humble self have been upgraded to the high social standing of a full fledged villager (even if it is as a servant) I hereby confirm that I will be doing everything within my humble powers to check the ills of the society (our society) and stand for the upliftment of all disabled (or not-too-abled). I will shout from the mountain and let the valleys echo, I will trudge in search of that Nivarna where all things good dwell, untill the breath leaves me.
Now, I guess it is right to say that the celebrations will go on for hours in my minds paradise.
To the elders, Una do well, My humble appreciations to you all. The palmwine should have arrived by direct courier now (western union has left the villages). Imbibe and think about good old days (they are always good compared to today).
Thank you.

peterosa
Apr 6, 2009, 10:00 PM
You are welcome my dear.

calist
Apr 16, 2009, 12:07 PM
This kind palm wine and cola nut wey no they reach elders front get as ebi. Know it that as long as you keep delaying the elders partikolars so also shall your …. Will be delayed. :)

BTW, chiakozie you are welcomed to the village square.

If you are ready oh, here are your visa interviews questions, abeg fold your sleeves and fire on. Do not forget to remember that any delay in response with attract the anger of the elders.:D

a) How did you get to know of NVS?
b) What prompted your decision to apply for a valid visa?
c) What are your hobbies?
d) Are you married, divorced, single with children or single and still search?
e) Where you born before, during or after the civil war?
f) Too many cooks spoil the brut true or false?
g) Provide 5 reasons for (f)

You have a minimum of 10 posts to have obtained your visa.

Ensure to respond to every and all questions coming your way on this thread.

Good luck
Calist
Chief of Staff

elgaxton
Apr 16, 2009, 12:33 PM
In view of the fact that my humble self have been upgraded to the high social standing of a full fledged villager (even if it is as a servant) I hereby confirm that I will be doing everything within my humble powers to check the ills of the society (our society) and stand for the upliftment of all disabled (or not-too-abled). I will shout from the mountain and let the valleys echo, I will trudge in search of that Nivarna where all things good dwell, untill the breath leaves me.
Now, I guess it is right to say that the celebrations will go on for hours in my minds paradise.
To the elders, Una do well, My humble appreciations to you all. The palmwine should have arrived by direct courier now (western union has left the villages). Imbibe and think about good old days (they are always good compared to today).
Thank you.

Welcome Chiagozie,

How u dey?

ehen! Make I gist u one small thing, forget sey ya status dey show sey u be villager, that no mean sey u don collect the OGBONGE VISA of no regrets

So my guy, just answer the questions wey the Chief of Staff post up there so that ur visa review process go kick -off.

See u later u hia!

Elgaxton

Director Village Homeland Security

emj
Apr 16, 2009, 02:11 PM
Eherm, make una no mind Chiagozie.....hin juess come scatter ground for nothing.....da kola-nut no reach me, neither did the bitter kola...even the Native Salad wey hin bin promise neva land;)

Make i go come ojare:arrow:

EMJ
Chairperson Board of Trustees JJCamb

Abraxas
Apr 17, 2009, 10:24 AM
Hi, my pikin, Chiagozie!

:sick:Kpu-ha! Kpi-he! Kpu-hi! Kpu-ho! Kpu-hu! (Make I clear my t'roat small, first).:sick:

Even sef, paa~paa, wey my crate of Dom Perignon, 77 joints of Fela cigar, and 50 litres jerry can of ogogoro?

Make yoo no make me vex~o! I say, no try me~o! Hmmmmmmmmmmmmmm...

Muchas gracias.

Don Juan-Carlos ABRAXAS (III)
Life President, Village Elders' Forum (Bar, Casino & Discotheque)

chiagozie
May 22, 2009, 11:41 PM
I don shit fo church!
wetin hapen bi sey my landlord com case mi commot fo house, na im i com lose the visa wey I take dey visit dis village. anyway, I de beg make I get fresh chance to show proper respect as I don get temporary visiting rights.
I go answer de questions dem.

a) How did you get to know of NVS?
E don tey wey ynash ey back now. A big bros befo, Uche Nworah na im show me road. E don tey sha!
b) What prompted your decision to apply for a valid visa?
As pa sey I don dey get small small change and fit afford to dey come visit elders small, na im i sey make i fo kukuma come reside small, the trnsport no too cost anymore.
c) What are your hobbies?
I like to write write and read read, even sf I dey try sing small and I dey write the sing dem myself, but my voice no gud reach to bi star oo.
d) Are you married, divorced, single with children or single and still search?
I dey search well welland any sista wey like my style fit show face, as long as sey she no go ban kunu and sobo.
e) Where you born before, during or after the civil war?
Ha my papa na boy soldier for abagana front, no na after civil war after festac.
f) Too many cooks spoil the brut true or false?
Not true.
g) Provide 5 reasons for (f)
with enough 1, cordination 2, know how 3, dedication 4,following ability and 5, a solid leader a thousand cooks can rival and surpase and one great cook.

I hope I have sooted the freyed nerves? I still dey ground o! Elders accept the kola wey don land so. Ogadima

E_Pluribus_Unum
May 25, 2009, 03:43 AM
hmm who can this (recycled) jjc be???

*thinking furiously*