21 Aug 2009 |
|
My Broda this Bank Wahala which bank you de keep your money? Yinka: How now? Uche: Baba Yinka, I dey o! How bodi Yinka: I dey O! Nnaa which bank you dey keep your money as all the wahala and katakatah for all these banks dey unfold? Uche: Bank ke, Bank ni? My money dey for under my bed and some wey I know need immediately I dig ground keep am. Yinka: How u go do that kind thing for this modern world? Uche Whatever, wetin be this kind modern world? So you want those women and men in designers suit inside aircon and mable buildings to continue to use dey money wey I get under the heat/rain of Eko to shine, buy house for obodo oyibo, send their children to oyibo school, buy private elikolpter? You try, go advice that your babe like that, me and bank don end. Yinka So if armed robbers come house nko, how you go do? And dey money go dey smell self for house Uche Armed robber even better pass these clean operators una call bank chiefs. Money dey smell ke, hmmm I like dey smell my broda. Yinka Wetin you mean? Uche If armed robber come I fit beg am make the take some give me some. But for the bank if they go under, my half self I no go get. Yinka Wetin you mean by that? NDIC insure your money now. Uche Old boy you kolo o…Na you no be modern man for this o. Yinka Wetin you mean be say I kolo? NDIC go pay you back what ever happen to the bank. Uche I think say you be Journalist? Can you tell me how many people wey don get their money for all the banks wey done fail for Nigia. Yinka Hmmmmm… Uche Don’t hmmm me….go find out. See you … for Savannah bank did you ask wetin happen to the depositors money? Did you ask and find out the bottom of the issue, or just the carry pen the waka about like say the pen na bomb…yeye man. You cant tell me who get he money for Savannah? Yinka Nnaa no abuse my profession o or question my intelligence o. Okocha get him money now? Wetin you mean? Uche After Okocha get him money, who else get him money? Okocha get him money by executive order from OBJ. Make I teach you further, you know say if armed robber come my house , even if de no remain anything, at least I know say the money don go, I go mourn and be sad, but at least the money don go, so I go start over again immediately to struggle. Yinka But it is in record, NDIC no say they still owe you. Uche You need to wake up for your sleep, I know my friends way don wait for Savannah bank to repay their money so tay the forget say years don pass and when they know how much time they don wait for the money wey dey tell them say e dey come for pipe line, some died for heart attack while waiting, and some kill themselves say it is not worth living. Yinka Anyways I don even know which bank to trust any more. Even an elder for church or Mallam for mosque dey tell you something u go dey doubt whether wetin he dey tell you na true…I don even know who to trust any more. Old man go lie, young man go lie, some go tell you say in the name of Allah/ God I dey tell u true. Some go say u know say I be born again I no go lie for you. Uche At the end of the day, my broda, you go find out say na lie dem dey lie patapata. Only God go help us for this our Nigia…I beg make I go sleep jo, hope say NEPA, abi PHCN go bring light so that I go sleep well. Yinka Ok, good night, take am easy when you go dey beat the mosquitos o…dey too go eat something o… Uche You be craze man…good night we go see tomorrow. Hopkins-Amachree, an information technology professional sent in this piece from Phoenix, Arizona
|
|||||||||||||||||||||||||||||||||||||||||||||







Your Comments
Please make The Square an enjoyable experience for everyone by refraining from gratuitous ad-hominem contributions, defamatory comments and off-topic posting. Such posts will be removed.